Ughelli Aproko Gist

Ughelli Aproko Gist Ughelli Aproko Gist Na Where We Dey Bring Una First Hand Aproko Gist.

14/08/2026

Olorogun Jaro Egbo Ksc come see waiting ur fellow local government chairman dey do for Lagos o.

If we talk now e go b like say na political party dey use us, we don dey beg u for long make u fix some roads for ughelli but all to no avail.

See post office round about wen u dey pass go office wen u for dey get allocation on a monthly basis nai b like d€ trap so, even if na fill u even fill am self make e for dey accessible na bad thing self.

Abeg nor make us talk make e nor come b like say na people dey use us even Rt Hon Sheriff Oborevwori na massive roads he dey construct why u nor fit follow same foot step? No single roads for ughelli.

One pastor for Ogun state don convert to babalawo.
13/08/2026

One pastor for Ogun state don convert to babalawo.

Una remember this olozighe wen we post some time ago wen go kpaki people things for Ighrovie? He don go tH!€f again .Vid...
13/08/2026

Una remember this olozighe wen we post some time ago wen go kpaki people things for Ighrovie? He don go tH!€f again .

Video dey come shortly.

12/08/2026

OKPEMURODE 🙆‍♂️

Landlord install hidden camera for he female tenants bedroom
D case dey with police as we dey talk like this so.

Olorogun Jaro Egbo Ksc we dey hail ooo, remember ughelli aproko gist fan’s and followers for this ur empowerment so we g...
12/08/2026

Olorogun Jaro Egbo Ksc we dey hail ooo, remember ughelli aproko gist fan’s and followers for this ur empowerment so we go know say e reach everybody.

11/08/2026

KENOMA KO JI, THIS YEAR NA FOR THE OWNER.

Luck don run against one Olozighe wen he name na Segun Daniel from Afiesere Community Ughelli, this olozighe specialize in moving people phones for party,he go Orhuakpor community on Friday during the burial ceremony of late CEO of Jodos mortuary to carry out his normal omila business but area gbab am. According to the olozighe he say he don kpaki more than 100 phones na about 20 to 30k he dey always sell dem, this same olozighe so na steady customer for effurun market.

This Oji so get wife and children for Afiesere oo, imagine how he wife and children go dey feel as dem they see their popsy for this kind condition .

First video na wen dem hold am for çřîME scene why the second one na after dem don cast,bind and deliver am from the spirit of oji.

This page does not support violence, just raising awareness.

Like and share our page.

10/08/2026

Matter wen pikin dey hide from papa na papa dey later settle am.

As una hide am reach say Hon Uzezi wen b commissioner for works nor dey cell since, shey b e don leak out now.

This na video wen court take remind am for two weeks for Okere today temple matter wen dem carry burst burst he he@d for PTI during APC stakeholder meeting.

Meanwhile Rt Hon Sheriff Oborevwori don suspend the Commisioner for works in definitely pending wen dem go finish he trial.

Olorogun Jaro Egbo Ksc ,  the chairman of ughelli north local government, we wan bring one critical observation to your ...
10/08/2026

Olorogun Jaro Egbo Ksc , the chairman of ughelli north local government, we wan bring one critical observation to your table this morning.

This na Afiesere junction, normally the road nor too good and the way keke dey park both left and right calls for concern, no where for vehicles and okada to pass cos the middle nor good at all, if car enter that place na b say na 2 weeks e go spend for workshop cos them must drop the motor engine and if na okada,both the okada and passenger go fall and land for hospital.

Chairman two things dey involve, either u do the middle of the junction, in which ever way motor fit take dey pass am or evacuate those keke to another place, possible beg agofure to allow keke dey park for that he park there so if e reach their turn to load them go come out so as to decongest the junction.

We nor go wait make bad thing happen first before u go take action,cos as God dey save people for that place so make we as human still do our own part.

Siegware

Make una share and like our page.

10/08/2026

Una Happy New Week ooo

Oya take mic
Tell us why u never give us aproko for ur area or sorounding

Address

Ughelli

Website

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when Ughelli Aproko Gist posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Contact The Organization

Send a message to Ughelli Aproko Gist:

Shortcuts

Share