10/08/2026
The President and members of the Ogu Youth Congress follow dey for the One-Day Retreat wey Ogu/Bolo Local Government Area host together with the Liberation Club of Ogu. The meeting na to discuss the development of Ogu community and how every son and daughter of the land go take be part of the development.
The President of OYC, Capt. Amb. Ibiebele Cosmic beg the leaders of the community say make dem help to do everything possible for the community to get some certain benefits wey dem dey miss due to one or two tins. Him also beg say make the community take the discussion of coronating new Amanyanabo as important matter.
Also, him talk say since last year wen him become President, the companies wey the youth body don meet for graduate employment dey always give them chance for engineers, but most of the times na graduates wey read other courses dey plenty pass.
Him advise say to go school na very good thing, but say as our youths dey go the school, make them remember say the community get access to maritime investments, so make dem also dey study courses like marine engineering and other maritime related courses wey go make dem get employment quick.
Him come thank the council Chairman and the Liberation Club for the better thing wey dem do to bring the summit make people come together to discuss development. Him also recognise the club for all their scholarships for students wey dey higher institutions and the ones wey wan enter. But him come beg them small too, say make dem also try to train other youths to learn skills wey dem fit take work, because companies dey look for skill workers more.
The meeting na for the new Alabo A.C. Iyaye Memorial Hall naim e take place on Saturday wey just pass.