Global PUSH Conference S.W.Y

Global PUSH Conference S.W.Y Annual Conference of the Divisional Youth of Christ Life Church SW1 Division.

Town Crier: Kere ooo ๐Ÿ“ฏ kere ooo๐Ÿ“ฏ! As e hot, As e hot, As e hot!Villager: Abeg wetin dey hot again?Town Crier: You rememb...
19/10/2025

Town Crier: Kere ooo ๐Ÿ“ฏ kere ooo๐Ÿ“ฏ! As e hot, As e hot, As e hot!
Villager: Abeg wetin dey hot again?
Town Crier: You remember say I tell una say I go come back tell una if an ogbonge (big, important) news don show face?
Villager: Yes, we remember well well.
Town Crier: Na anoder ogbonge news don land o! Una no say me, I be olofofo (town crier/gossip), abi?
Villager: Oya, yarn (talk) the matter, no waste our time because time na money for we hand.
Town Crier: I don get the time and the day wey the DYC FESTIVAL go hold!
Villager: ๐Ÿ’ƒ๐Ÿ’ƒ๐Ÿ’ƒ๐Ÿ•บ๐Ÿ•บ๐Ÿ•บ, Oya, give us the gist (details) sharp sharp!
Town Crier: Na from the meeting wey our Oba (king) just finish now I dey come. He say make I tell una say this year DYC FESTIVAL go hold ooo, on November 29, 2025. And the theme for the festival na Through him mercy (BY HIS MERCY), wey dem comot for the festival overall manual page, EZRA chapter 9, number 8 to 12. Na wetin him talk be that.
Villager: This one na correct news! Make we go dey tell our people now, since you don tell us first.
Town Crier: As I don come, I suppose thank una because if no be for una, many people no go hear this matter. Also, the Oba say make I tell all of una make una go to all the four villagesโ€”Living Spring, Seed of Abraham, New Dominion, and Dominion Arenaโ€”wey we get friends, make we go remind them, because this festival na for all of una wey be villagers, most especially, and all the neighbours like Rccg, Winners, CAC, MFM, C&S and so on.
Villager: We go do pass wetin the Oba send us to do!
Town Crier: Before I forget, the place wey e go hold na Village Square, Dominion Arena, behind Ejigbo Garage, Dada Estate, Osogbo, Osun State. Abeg, miracle, signs, and wonders go dey, and menu menu (plenty food/refreshments) too go dey!
Villager: Greet the Oba for us and tell am say happy festival preparation. And the festival go successful well well for him time ooo. The God wey help all the other Obas before am go help am too.
Town Crier: I go deliver all una messages to the Oba.
Town Crier: If anoder ogbonge news show face, I go surely bring am come.
Town Crier: I think say I don talk well, abi?
Villager: You don talk well ooo!

Ke re oo! ๐Ÿ“ฏ๐Ÿ“ฏ  Villagers: Wetin dey happen town crier? All dey okay?  Town crier: Na better gist oh!  Villagers: Abeg, no...
12/10/2025

Ke re oo! ๐Ÿ“ฏ๐Ÿ“ฏ
Villagers: Wetin dey happen town crier? All dey okay?
Town crier: Na better gist oh!
Villagers: Abeg, no keep us for shadow, tell us sharp sharp!
Town crier: The king yan say make una dey ready for our yearly DYC festival wey go happen for November, but date no set finish.
Villagers: Why you go dey give us half story?
Town crier: Sorry oh, I go come back with full tori when e clear. But I no fit gree say make una no sabi the gist at all, so make una dey prepare small before date drop. Make everybody ready!
Villagers: This one go better pass last last festival abi?
Town crier: Our king no dey play, better tins dey come!
Villagers: Ok na, we trust our king.
Town crier: Abeg go yan your friend dem wey no dey here say DYC festival dey come November 2025, make dem prepare.
Villagers: No wahala, we go tell dem.
Town crier: As I hear more from king, I go dey come update una. Now make I run go other villages yan dem.
Villagers: ๐Ÿ’ƒ๐Ÿ’ƒ๐Ÿ’ƒ๐Ÿ’ƒ๐Ÿ’ƒ๐Ÿ’ƒ

Address

Christ Life Church Dominion Cathedral
Osogbo

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when Global PUSH Conference S.W.Y posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Contact The Organization

Send a message to Global PUSH Conference S.W.Y:

Share