15/05/2025
Uruguay former President José Mujica, wey be ex-guerrilla, don die at di age of 89.
Mujica wey become well-known political figure for Latin America and beyond, lead Uruguay from 2010 to 2015.
Di politician, wey dem know as “Pepe”, get di nickname world "poorest president" becos of im simple lifestyle.
“Thank you for evritin you bin give us and for your deep love for your pipo,” current President Yamandú Orsi write on X.
E neva clear wetin kill Mujica, but e bin don dey suffer from oesophageal cancer.